So today a new series begins…*gen *gen!
I call it “p.s. I love Nigeria”
Every Friday I’ll write a bit about Nigeria, it can range from any topic – fashion, news, history, whatever – but it will be at least slightly related to Nigeria, and maybe with some Nigerian vernacular… so let’s go!
—
So me I dey go ge-gently I dey mind my business sha… I be wan leave office make I go my house… then… gen gen… the guy con block driveway, say e no wan move sha, say na the other driver suppose move. Guy one go talk to am softly softly say oga abeg, she wan go, and your car dey block her car… oh boy no move… guy two con ask am ge-gently say oh boy abeg, the young lady wan go her house, guy three, guy four, guy five go beg the man… the man no gree… na im they con dey shout… the guy still no gree… na i’m I carry my sef commot for car and I con dey shout … I no even know wetin I dey shout… long story short sha… guy finally move im property… I con dey laugh… na wa oh!
okay so can you imagine? Some Nigerians do not like to be treated respectfully. You treat them calmly, you explain things to them gently, but no they want you to shout (AKA yell) at them. I used to think that shouters were angry people, but not in Nigeria… it seems like you just have to shout and insist to get things done, or people will think you’re stupid and try to run all over you…
Now my brothers and sisters I ask you, do you think this new shouting habit will affect my personal relationships? I hope not oh!
ahhh welll… I’m learning…
p.s. I love Nigeria